Thursday, November 18, 2010

Baba God; na cry i de so ....

Baba show us love, once and for all ooo
no let us fall ooo, Baba God we dey beg ooo

Baba-mi jo, i dey beg u, come down ooo,
Baba come sho dat undying love, wey we don dey hear since
for i think say na now bi the time ooo; Osa-no-bwa...
as i dey look all around me so, na evil full ground
bribbing and curroption, na wetin everybody de look ooo
Baba God, no let me fall now, bcos i don tire; well, well
dis road e no easy for man pikin, tins no just gel at all
i don try all the tin wey i sabi do ooo, but e no dey work
wetin i dey see so na people wer no dey feel you, i swear
u know as i be, say i no fit fail u, but ground no level,
u no go blame me say i too wan go join dem, collect coins
na blood dey my body,
tins just dey fall yakata, i no fit stop am
if i sabi the way, i no for call u, but as i no kno...
dat na why i dey call your name so, make you come ooo
bcos tins don hard, na egunje and pepper dey rule ooo
boyz no get time again to dey follow good way
na person wey no get liver, na im dey do good boy,
you kno say na you bi Baba lo-ke, make u come sho mi the way
Oluwa mi, mo fi aye mi be yin ooo, Oluwatosin ni oruko mi
Oritse, ah, you dey look dem as dem dey kill so
no go fold your arms, see all the good person die finish ooo
my papa talk say, na you bi the Baba God ooo, say na your hand ooo
the tin wey i dey see so, I no lie you, I don dey fear
my people dem don turn ooo, no bi as i think am, e don change
dem side no get part two, no bi home video bi dis ooo
mi i don look around dis place, ah Baba, Omo make you sho...
so dat u fit cleanse dis place, so dat tins go stedy
bcos dem don dey do juju, bcos maga no gree pay... na wa ooo
you don take style look the country wey dem dey call Niaja?
Baba God, if you see am, you go know wetin i dey yarn, you fit fear
i no fit lie you now... how you feel wen you see dem person
sho dem love for all the face of the bad belle people wey we get
na bcos pepper no dey, dat na why dem dey craze kill each other
if you sho for office, no wash ground wella, nobody go send you
Oghene, the Almighty God, no bi lie ooo, na cry i dey cry so ....
Ah! Baba mi ooo, Oluwa mi ooo, Oritse mi, mo be yin, ku aye mi ooo
come bless us (Nigerians and Africans) most high God...

No comments:

Post a Comment